Lyrics
Oritse Femi – October 20th Lyrics
Popular Nigerian Artist has dropped a new single titled ‘October 20th’. This song is in memory of our fallen heroes that died from the protest on October 20th 2020. Enjoy the Lyrics below
Ale oh oh
Oma Nigeria dede
Taliban won start to dey speak again oh
And if I open my mouth yawa go dey
Taliban won start to speak again oh
If I open my mouth, gbege go dey,
Oya wetin dey sup
Wetin dey play
Why we nor dey sleep with our 2 eyes again
Why nobody dey talk no one get nothing to say
Dem just dey leave the country make e spoil every day
Doesn’t mata any name wen dem go call am
Na the same pipo go still rule us make you know
Dem dey carry gun across the borders,
na the same guns dem dey use kill our brothers,
Una must to finish us today oh
how many people una go kill?(hmmmmm)
If una no kill us today, so many trouble go dey o,
Soul of the innocent ones wen dem don kpai
Dem don dey Para now
Dem dey kidnap dey rape children
Our leaders nor ask dem why(why)
Our legislators nor fit yarn for us
If dem yarn e go affect their self interest
The way the thing dey go
Make all man make all mandey on guard and self defense
Ona know how we get here today
That one na story for another day oh
As we dey live in fear every day
Shey na so my pipo dem go deh oh
Hmmm hmmmm hmmmm
Una must to finish us today oh
how many people una go kill?(hmmmmm)
If una no kill us today, so many trouble go dey o
Hmmmm hmmmm hmmmm
